Showing posts with label Retribution. Show all posts
Showing posts with label Retribution. Show all posts

Wednesday, November 12, 2008

Waterloo

Ok… I gasto write this one in broken as I no want make yawa gas. First let me introduce 3 characters – Mr A, Mr B & Mr C.

Mr B dey sit opposite Mr A. Since dem begin sit together, Mr B dey pull Elton John moves - Flick im hair one how, suck im pen suggestively, rub im pen suggestively, bat im eye, stare at Mr A, stroke im chin/brow, lick im lips etc. Man – na like sey Mr B no get work o and im dey direct am at Mr A – CHEI!!.

Mr A just dey boil inside, dey ignore Mr B but wetin Mr A fit do?? Na free world and persin im fit do whatever im like. Like play, like play, Mr B day come reach. Mr A,B & C s’pose get conference call but Mr A dey run late. When Mr A reach meeting room, na Mr B and Mr C dey der - dem dey talk, dey wait. The people dem dey call neva come online so Mr A just commot, go back to im desk. As Mr A dey leave though, im notice sey Mr B dey one side of conference room and Mr B dey another – Mr B person dey lick im pen like im usually dey do when im siddon Mr A front.

Mr A just look the guy commot. Ok now, like 5 mins later, na im Mr A return come join the conference call. Still the other participant never join the call and although the conference room big like 9ja palour – na next to each other both of Mr B & Mr C now dey - dey explain something for paper. Hmmm… Mr A just make im excuse, go back to im desk.

Next time wey Mr A return, Mr C (obviously excited) still dey explain something to Mr B but now lying on-top conference table with im back to the door. TRUEEEEE o. Mr A no even enter – im just return to im desk and dialled in from im phone.

Mr B & Mr C returned from the conference room long after meeting don finish (Mr A just dey look like persin wey no know notin). Mr B returned and dey look flushed – no be Mr A’s father business, im just carry go dey work.

After this, na im story come start… Mr C come begin get explanation to every of Mr B’s problems and I mean EVERY. Mr C dey hardly miss opportunity to explain “something” to Mr B and (un)fortunately na corner Mr B dey sit (and obviously facing Mr A).

Mr B fit comment say “1+1=2? hmm” Quick, quick Mr C don come, pull chair dey “explain”, dey draw close. Simple question fit take like 30mins o – jesu!! Come know the funny thing?? Mr B dey try run from Mr C now as Mr C just dey another level – if Mr C dey come, Mr B go dey talk “it’s ok, I’ve figured it”. Mr C no dey even hear all that one – im gasto give im lecture and in close proximity.

Mr B just dey look morose – can hardly complain about something he started and can’t now seem to stop when seemingly he's no longer interested or inundated. Mr A just dey laugh inside…waterloo na a terrible place to reach!!